Nollywood actor, Junior Pope is dead

  👉WATCH THE FULL VIDEO HERE



Die sudden death ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope don make di Actors Guild of Nigeria (AGN) announce serious actions for di industry.

Three crew members wey dey involved for di boat accident wey take di life of di Nollywood actor on Wednesday 10 April 2024, still dey miss.

Dem don identify one Mr Friday wey also die for di incident and three deadi bodies still dey miss.

As di matter happun, di president of di actors guild Emeka Rollas no gree as im announce serious actions for di industry sake of di recent sad incident

Di news of di death of Junior Pope first hit di social media for Wednesday night, later tori come say im dey alive. E no too long n aim Oga Rollas confam dis for post e do on im Facebook account on Wednesday, 11 April say Junior Pope no make am alive.